![Meghan Markle biography [Where is Meghan Markle from?]: Queen Elizabeth grand-pikin Prince Harry Duchess of Sussex, Rachel Meghan Markle profile](https://ichef.bbci.co.uk/news/640/cpsprodpb/B42A/production/_106622164_meghanpro_reuters.jpg)
Wia dis foto come from, Reuters
Di Duchess of Sussex inside Morocco in February 2019
Meghan Markle don already make her name as an actress, campaigner and blogger before she marry Prince Harry for May 2018 and become di Duchess of Sussex.
Before she meet Prince Harry, she bin dey popular for one US TV drama “Suits” wey she play di role of a lawyer, Rachel Zane.
Wen she turn member of di Royal Family, she quit her acting career – and occupy herself wit di life of a working royal, as she dey use di platform to showcase charities and matters wey dey close to her heart.
She become a mother for May 2019 but within a year she and Prince Harry don waka comot from working as members of di Royal Family and start dia new life for North America.
She dey live for California now and dey expect her second child.
Prince Harry bump forearms wit Craig David wen dem meet at di end of once church service – while Meghan choose to hug him
Early life
Dem born Rachel Meghan Markle for 4 August 1981, she grow up for di posh part of Los Angeles.
Her mama town na one area dem dey call di “Black Beverly Hills”.
Meghan bin attend private primary school for Hollywood and start dey campaign for gender equality when she still dey small.
Wen she dey 11 years old, she write letter to di then US first lady, Hillary Clinton, on top one washing-up liquid TV ad strapline: “Women all over America are fighting greasy pots and pans.” Wey she say e no…